Rambling Words Of Murderous Terror Kingpin Who Masterminded Okuama Massacre Of 4 Officers, 13 Soldiers of Nigerian Army

The unidentified terror leader of the gang that gruesomely murdered 17 soldiers of Nigerian Army has finally owned up to the killings in a Pidgin English TikTok broadcast that went viral.

The unrepentant terror leader showed his face but didn’t identify himself beyond claiming that his father retired from the Nigerian Army last year.

Below are the rambling minds and words of the murderous kingpin.

“This one na e be my last video wey I go do concerning this Okuama and Okoloba fight. Okuama and Okoloba dem get land issues. From land issues small crisis come de dey. Una wey be Ijaw people wey Federal Government give power to dey do bunkering, to dey burn diesel, dey use the same army dey escort their own go steal, dey betray their own blood.

“That man e go use him army carry people from Okuama community – three people wey dey carry dey slaughter them. Now dey don dey come back to come carry community leaders and una know very well say once the community leaders are captured the youths are powerless. The action take place una dey make comment say na peace keeping all dose army come. Point of correction: no army come for peace keeping; dem dey fight in favour of Tompolo because Tompolo ordered them to do so.

“Una dey say make I show my face. All this una comment wey una dey comment na just ordinary writing – na writing una just dey write. If I no fit talk true for this my land e no get where I go go wey I go talk true wey una go believe am. Na this video be the last video wey I go do. My papa na retired captain for dis Nigeria; he died last year; retired as a captain with the army and I don lose six of my friends and relatives for dis Nigeria.

“Remember, as an army dis Nigeria is not worth dying for as a country. I dey let you know so if una like make una carry dis matter here to the next level; if una like make Federal Government declare me wanted – I’m proud of it; yes, I’m proud of it. Una dey say ‘show your face’. If I show my face wetin you go do me? Wetin you go do me? So to talk true for dis country now na crime? No wonder why dey say truth is always bitter.

“Crisis dey between two community, una no fit call the elders, una no fit call the leaders to settle the issue amicably; you dey oppress one side for the other side, you dey call am peace keeping; na so dem dey keep peace? Okay, na una go school pass! Na una know the law pass!

“Na so oppression this country eh! If no be for one thing eh I for say eh make e be like that: north dey your north, south dey your south. All army if you dey serve this country serve with sense. If you be police police with sense; this Nigeria your country is not worth dying for. I dey tell una make una get sense.”

Related posts

Poverty, Professors, And Policy

NEMA Crew Monitors Niger, Benue Rivers Over Release Of Water From Cameroon’s Lagdo Dam, FG Warns Of Flooding In 15 States

Nigeria: Troops Eliminate 8 Terrorists, Rescue 40 Hostages And Intercept Arms Courier, Seize Ammunition

This website uses Cookies to improve User experience. We assume this is OK...If not, please opt-out! Read More